US strikes in Nigeria: Trump warn of more airstrikes in Nigeria if 'killing of Christians continue'
Wia dis foto come from, ReutersWetin we call dis foto, Last year, Trump bin declare Nigeria a "country of particular concern" becos of wetin e say be "existential threat" to dia Christian populationArticle InformationAuthor, Makuochi Okafor, Role, BBC Africa, Reporting from, Lagos, one hour wey don passRead am in 4 minsUS President Donald Trump don warn say im fit order more airstrikes on Nigeria if dem continue to kill Christians for di West African nation.For inside one wide-ranging interview wit di New York Times, dem ask Trump weda di Christmas Day strikes for Nigeria northern Sokoto state, wey target Islamist militants, be part of a broader military campaign."I for like make am a one-time strike. But if dem continue to kill Christians, e go be a many-time strike," e tok.Nigeria govment don reject Trump earlier accusations, wey claim say dem fail to protect Christians from jihadist attacks. Di govment say "Muslims, Christians and dos wey no identify wit any faith" dey targeted.Claims of genocide against Nigerian Christians begin spread last year for some right-wing US circles - but organisations wey dey monitor political violence for Nigeria say most victims of di jihadist groups na Muslims.Wen dem question am on top dis for di interview published on Thursday, Trump reply say: "I think say dem dey kill Muslims too for Nigeria. But na Christians dey affected most."Nigeria population of more dan 230 million pipo dey roughly evenly divided among Christians, wey most of dem dey di south, and Muslims, wey mostly dey for di north.For di past 15 years, di north-east of di kontri don suffer from one devastating Islamist insurgency for di hands of jihadist groups like Boko Haram and dos wey get connection wit di Islamic State (IS) group, wey base for Borno state.Di kontri also dey face oda serious security issues for different regions, wey include criminal kidnapping gangs, clashes ova land and separatist unrest.Di US Christmas Day strikes hit two camps wey one jihadist group wey di name na Lakurawa dey operate for di largely Muslim state of Sokoto, north-western Nigeria near di border wit Niger. E still neva dey clear if any casualties dey as neither di US nor Nigerian govment din provide figures - and no update de on di outcome of di attack.Lakurawa bin establish dia foothold for di border region a few years ago. Dem come from di areas north of Nigeria for di Sahel.Di US and Nigerian govment bin tok afta last month airstrikes, say di militants dey linked to IS groups for di Sahel - although IS no link diasef to any of di group activities or announce relationship to Lakurawa as dem don do wit oda groups for di region wey dem dey support.For di wake of di strikes, Nigeria Foreign Minister Yusuf Maitama Tuggar bin tell BBC say na "joint operation" and e get "nothing to do wit a particular religion".Di foreign minister bin add say di strikes get di full approval of Nigeria President Bola Tinubu plus di involvement of di kontri armed forces.